E no longer be news say Upper Sharia Court for Kano don sentence singer Aminu Yahaya Sharif to death for blasphemy, so di question wey many dey ask now na dem go hang Aminu immediately or how e go be?
Well, according to judge Aliyu Mohammed Kani wey give di verdict, di singer get 30 days to appeal di ruling for court of appeal.
Wetin fit happun for Court of Appeal?
Barrister Musa Salihu na legal practitioner for Nigeria’s capital Abuja and e tell BBC say wetin go happun for Court of Appeal be say dem go set aside Sharia Law wey convict Aminu and use Nigerian laws.
“If Aminu decide to appeal im judgement with di kontri’s Appeal Court, his chances dey very bright because dem no go use Sharia law judge am but Nigerian laws and codes wey go likely see di judgement overturned for something lighter.” E tok.
What next for di singer?
Baba Jibo Ibrahim na tok-tok pesin for Kano state courts. E tell BBC say e no dey possible say dem go hang Yahaya immediately because Abdulazeez Inyass wey get similar judgement for 2016 still dey detention.
“Di judgement no go take effect immediately because di convict get chance to appeal even after another conviction govnor need to sign death warrant for execution to happun.” E tok.
Dis na also wetin tok-tok pesin of Kano prisons Musbahu Lawal tok regarding wetin go happun to Aminu.
“Govnor need to sign death warrant first before execution go happun and most times dem no dey sign, so di convicts dey stay with us.”
How Sharia dey work for Nigeria
Na 12 northern states for Nigeria dey use Sharia law and na only muslims dem fit try for Sharia courts.
Sharia system get im own court of Appeal and dey handle both criminal and civil matters involving Muslims and Muslims fit challenge di judgement of Sharia courts for normal Nigerian Court of Appeal and Supreme Court.
Sharia judges wey dem dey call Alkalis get Islamic and western education.
Any case wey involve Muslim and non Muslim, di Muslim get right to choose which court e wan make dem try di case. Sharia court fit only try non Muslim if e give written consent.
Some of di sentences wey Sharia courts fit give include floggings, amputation and death penalty depending on di crime.
Wetin be blasphem for Islam?
For Islam, Blasphemy na when pesin disrespect or abuse important figures for Islam or any law wey dey inside Islam.
Di worst na when pesin tok bad tin about God or prophet Muhammad dat one na death penalty while odas like abusing or disrespecting top disciplines or islamic laws get various punishment
According to experts, di blasphemy laws differ and no be all dey lead to death penalty.
Yusuf Sani wey dey well versed for Sharia law e tok say pesin wey disrespect or abuse disciplines of di prophet no go get same punishment as pesin wey abuse di prophet himself.
“So wetin pipo suppose know about dis blasphemy laws be say na step by step. After Allah next for Muslims na prophet Muhammad SAW and anybody wey disrespect those ones fit get death sentence.”
“Even regarding disciples of the prophet dem get levels, for example Abubakar, Umar, Othman and Aliyu na top so pesin wey abuse or disrespect dem go also get punishment although e no go reach di first case own.”
Source: www.bbc.com