LawCare Nigeria

Nigeria Legal Information & Law Reports

Nigerians in Ghana: Nigeria business, goment react afta Ghana authorities close dia citizens shops – See reason wey di West African nation give

Nigeria government/Ghana goment

Nigeria foreign affairs mistier, Geoffrey Onyeama say dem go take urgent steps concerning di closure of shops wey belong to dia citizens inside Ghana.

Oga Onyeama tok dis one afta one viral video wey show Ghana authorities dey close di shop of one Nigerian inside Tip Toe Lane, Accra.

For di video, di owner shop say di authorities dey demand make im pay $1m before e go fit continue with im business inside di kontri.

But Ghana Ministry of Trade say dem no tell Nigerians and oda foreigners to pay $1m tax before dem fit do business

Head of Communications, Ghana Ministry of Trade, Prince Boakye Boateng tell BBC Pidgin say foreign business owners need to prove say dem don invest $1m for dia business activities inside di kontri.

“As e stands now, dis na di position of di law, You must prove say you don invest $1m for di business wey you dey do, dis money belong to you. No be say we levy $1m tax on anybody.”

Ghana Law for Foreigners wey wan do business

Concerning why authorities close some stores recently for di kontri, oga Boateng say na because dem no fulfil di requirement wey dem need to get before doing business inside di kontri and dem be;

  • Register di business with di correct department of di business entity
  • Prove say di company dey pay dia taxes
  • Di company need to dey certified by di Ghana Standards authority to know if di goods wey dem carry enta di kontri meet up with di right standard
  • Di company must prove say dem don invest $1m for dia business activities.

Anoda issue wey oga Boateng mention why dem also lock some Nigerian shops na Retail trade;

“Ghana na sovereign state and e get law, even though we don sign up to international treaties.”

“Di laws of dis kontri reserve Retail Trading to Ghanaians only, so weda you be Nigerian, India or whoever, you no suppose to engage in retail trade especially for our market inside Ghana.”

Wetin we call dis foto,

National Association of Nigerian Traders don bin protest for Ghana for 2018

According to am, Retail Trade na petty trading wey be buying and selling of goods. E say foreigners fit bring in di goods, do wholesale business-dat na supply am but dem no fit begin dey do retail trade (petty trading).

E add say no be only Nigerians dey break dis retail trade law but majority of di pipo wey dey engage in retail trade well-well na Nigerians.

Ghana Ministry of Trade advise for Africa Businessmen inside di kontri

Head of Communications, Ghana Ministry of Trade, Prince Boakye Boateng don advise foreigners on what to do;

“Di advise wey I dey give to my Nigerian brothers and sisters wen I meet dem be say nobody go stop you from doing legit business.”

“Nothing prevent African traders from coming today, pulling resources togeda and having a place like Ivorian Mall, Nigeria Mall and everybody go gada dia and sell. But e dey like say dem prefer ‘me’ ‘me’ kind of business.”

“Plenti oda foreign business dey for Ghana like; Shoprite, Koala shopping mall, China mall and odas and authorities neva go any of dem to close dia shops.”

“If na di market wey we don reserve for our petty traders na im oda nationals wan come compete with dem, e no go work.”

Source: www.bbc.com