LawCare Nigeria

Nigeria Legal Information & Law Reports

FIRS and NIPOST: Stamp duty palava make Nigerian goment agencies fight themselves for Twitter

NIPOST AND FIRS

Two sister agencies, Nigeria Postal Service (NIPOST) and di Federal Inland Revenue Service (FIRS) dey drag their self for twitter on top who suppose dey issue Stamp Duties.

Di Nigeria Postal Service say NIPOST na di only agency wey dey charged wit di responsibility of producing adhesives stamps and any money wey comot from di sale of such stamps suppose enta NIPOST pocket.

Di Chairmo of NIPOST, Maimuna Abubakar for series of tweets wey she post on twitter accuse FIRS say, di sister agency wan steal dia mandate. She say di agency no only wan steal dia stamps, but also dia ideas, wey dem don work for since 2016. Madam Maimuna say FIRS don begin dey sell stamps instead of make dem buy from dia hand.

She bin quote some laws to support her claims.

Skip Twitter post, 1

End of Twitter post, 1

Skip Twitter post, 2

End of Twitter post, 2

Skip Twitter post, 3

End of Twitter post, 3

Skip Twitter post, 4

End of Twitter post, 4

Skip Twitter post, 5

End of Twitter post, 5

For im response, FIRS Director Communication and Liaison, Abdullahi Ismaila Ahmad say e dey unfortunate say NIPOST oga no sabi di difference between Stamp Duty and Postage Stamp.

He explain say NIPOST work na to develop, promote and do any thing wey relate to postal services at reasonable rates but FIRS work na to assessing, collecting, and accounting for all tax types including Stamp Duties.

Di FIRS oga say di stamp duty wey NIPOST dey collect dey illegal and di agency dey determined to collect all di money wey NIPOST don collect from di illegally operated Stamp Duties Account into di federation account.

FIRS also claim say dem dey follow wetin President Muhammadu Buhari for di recently Inter-ministerial committee on the recovery of stamp duties from 2016 till date tok.

Skip Twitter post, 6

End of Twitter post, 6

Skip Twitter post, 7

End of Twitter post, 7

Skip Twitter post, 8

End of Twitter post, 8

Skip Twitter post, 9

End of Twitter post, 9

Madam Abubakar call on Nigerians to epp dem get justice even as she tweet #justicefornipost say make Nigerians no keep quiet and allow FIRS kill and bury NIPOST.

Abdullahi Ismaila Ahmad say make right thinking Nigerians bone wetin she tok as about Stamp Duties as by law na responsibility of di FIRS.

Wetin be di work of NIPOST

NIPOST na government parastatal wey dey established by Decree 41 of 1992 and dia work na to develop, promote, and provide adequate and efficiently coordinated postal services at reasonable rates.

Di agency also get di responsibility of printing and providing postage stamps for payment of postage tariff and payment of stamp duties by di decree No. 18 of 1987.

Wetin be FIRS work

Federal Inland Revenue Service na di agency wey dey responsible for assessing, collecting and accounting for tax and other revenues wey dem go pay to di Federal Government of Nigeria.

Apart from to collect tax, di agency dey do plenty online services like e-stamp, e-registration, e-filling and and many others wey dey dia website.

Wetin be Stamp Duty

Stamp duties na tax wey pipo or organization dey pay to federal or state government on documents also known as instruments for di purpose of di Stamp Duties Act) such as Conveyances on Sale,

Bills of Exchange, Promissory notes, Agreements, Contracts or even documents such as Letters and Certificates of admission, Instruments of Apprenticeship, Insurance Policies etc.

Di payment of Stamp Duties dey backed by law under di Stamp Duties Act 1939



Source: www.bbc.com