LawCare Nigeria

Nigeria Legal Information & Law Reports

Blasphemy in Kano: Sharia laws wit capital punishment besides Aminu Yahaya Sharif death sentece in Nigeria wey you fit no know

Yahaya Shariff Aminu Kano

Wetin we call dis foto,

Yahaya Shariff Aminu death sentence land on Monday 10/08/20. Protesters bin call for action against di musician.

As discussions dey continue over di death sentence wey Upper Sharia Court give Aminu Yahaya Sharif on Monday, dis na some sharia laws and dia capital punishment wey you fit no know.

Blasphemy

For Islam, Blasphemy na wen pesin disrespect or abuse important personalities for Islamic religion or any law wey dey inside islam.

Di worst na wen pesin tok bad or bad mouth tins about dia God or Prophet Muhammad – dat one na death penalty.

While odas like abusing or disrespecting top disciplines or islamic laws get various punishment.

According to experts di blasphemy laws dey type by type and no be all dey lead to death penalty.

According to Yusuf Sani wey be sabi pesin for Sharia law e tok say pesin wey disrespect or abuse disciplines of di prophet no go get same punishment as pesin wey abuse di prophet himself.

“So wetin pipo suppose know about dis blasphemy laws be say na step by step. After Allah next for Muslims na Prophet Muhammad SAW and anybodi wey disrespect those ones fit get death sentence.”

“Even regarding followers alias disciples of di prophet dem get levels.

For example Abubakar, Umar, Othman and Aliyu na top so pesin wey abuse or disrespect dem go also get punishment, although e no go reach di first case own.”

Wetin we call dis foto,

Noose

Sex outside marriage

For dis law, Mallam Dauda Ayuba wey be imam tok say for case wey involve sex outside marriage three pipo gatz take eye see di kerewa happun alias witness di deed wit dia koro koro eyes and three of dem must agree in front of a judge before sentencing go happun.

And di punishment na 80 strokes for pipo wey neva marry before or stoning to death for married pipo or those wey don marry before.

“Di three witnesses must catch di fornicators ie di pipo wey entangle inside di kerew in action without any doubt, if one of dem dey doubt then di case no go work. So if three of dem must agree for di case to move forward.”

“So for unmarried pipo wey commit fornication di punishment na 80 strokes of di cane while married pipo or those wey don marry before di punishment na stoning to death.”

Wetin we call dis foto,

An example of hangman’s noose

Drinking alcohol

For dis alcohol mata, one of di most popular sheiks for Nigeria Dr Abdullahi Usman Gadon Kaya tell BBC say di punishment na 40 strokes of di cane afta dem catch di alcohol drinker or e confess himself.

“So for dis case na either dem catch di Muslim red handed dey take alcohol or e bring himself to confess di act. Wetin go happun be say e go chop 40 strokes of di cane wey hopefully go serve as deterrent to am and odas.”

Wetin we call dis foto,

Noose

Stealing (Tiff-Tiff):

No be all types of stealing dey lead to cutting off pesin hands, according to Dr Abdullahi.

Wetin pesin steal must reach ‘Rubu’i dinar’ dat is money wey reach lowest Islamic payment for dowry.

“If pesin steal below Rubu’i dinar dem no go cut im hand.

But if e steal wetin reach dat one, dat is money wey reach to pay aa dowry, currently for Nigerian currency i think na N20,000k di punishment na cutting of hand.”

Anoda thing be say na di right hand dem go cut off afta dem find di pesin guilty alias conviction and if offender steal again di left hand.

Wetin we call dis foto,

Sharia court in Kano sentence Nigeria musician to death for blasphemy of Prophet Mohammed

How Sharia dey work for Nigeria

Na 12 northern states for Nigeria dey use Sharia law and na only muslims dem fit try for Sharia courts.

Sharia system get im own court of Appeal and dey handle both criminal and civil matters involving Muslims and Muslims fit challenge di judgement of Sharia courts for normal Nigerian Court of Appeal and Supreme Court.

Sharia judges wey dem dey call Alkalis get Islamic and western education.

Any case wey involve Muslim and non Muslim, di Muslim get right to choose which court e wan make dem try di case. Sharia court fit only try non Muslim if e give written consent.

Some of di sentences wey Sharia courts fit give include floggings, amputation and death penalty depending on di crime.

Source: www.bbc.com